SinghDude
Chief Sports Analyst
http://www.supersport.com/football/super-eagles/news/130108/Messi_don_become_Senior_OgaLionel Messi don kollect in numba four straight Ballon d'Or ( na World best playa award b dat) for Monday as pipu dey expect, afta d ogbonge year wey in bin get, wey even see am scatta Germany Legend Gerd Muller rekod wey dey tey tey since 40 years wey pass for the numba of gold wey pesin don score inside one year.
Messi, wey na 25 years and come from Rosario side for Argentina, and bin end 2012 wit 91 gols bin tok even before in kollect the award say wetin concern am na how Barcelona go take improf, do beta tin as per dem allow Madrid chop LaLiga for dem head, and dem also comot for Champion Lig.
" I no tink say na my best yearbe dat, i no dey look dat kain tin, for my side, wetin you win wit your tean na im impotant pass" Messi tok as in take remind say na onli Spanish Cup Barca win for 2012.
" The Lig, Spanish Cup abi Champion Lig dey more impotant dan any personal rekod wey pesin fit kolec, e no too mean anytin to me sha" Messi add jion come relate say in and the odas wan win evri everi wey dey ground becos lass year na dissapointment for dem
Messi sef sabi say pipu no too send am becos in neva win any Cup with in countri Argentina, so dem no dey look am as the greatest footballa wey do live, even thpugh Johan Cruyff belif say dat one na small mata if Messi fit win am again.
In sef gree say wetin dey in mind now na how to take win World Cup for Argentina wey dem go play for Brazil for 2014, but in form wen in wear Argetina jersi no be like wen in dey inside Barcelona 'blaugrana' own
" I still get dream say one day i go be World Champion wit Argemtina come add Copa America join ( na South America nation cup b dat)
" And i know say i go do am, i sure wella"
Histori sef no fit separate Pele and Maradona matta, the k-leg too much,but nobodi fit argue who dey run things now, Messi tap pass for dis time wey we dey. The way in dey dribble, dey create be like Iniesta wey come secon and in finishin sef dey the same level wit Cristiano Ronaldo wey come numba three
Messi dey combine evri come join in kreativity, plus in fit add say in don win Champion Lig three time and the onli one wey Ronaldo win even come from the time wey in dey Old Trafford.
Messi don nack Fifa Club World Cup two time for neck and na im dey hol the rekod for d highest gol wey pesin don score wit 283gols from everi kompitishun evenn as in never settle sef.
Na onli Michel Patini, Johann Cruyff and Marco van Basten don win the Ballon d' Or for three years strait, but Messsi sef don troway dat one comot
" Messi go win am pass everiboi for d histori of Ballon d'Or" Cruyff bin predic
" In fit land five, seix or even seven sef, nobody near am, in levels too much"
For outside football sef, Messi no too dey show inself like in rival Ronaldo, but the guy hamma no be small, in get kulele buku from all the kontrak wey in sign wit plenti pipu, na the Adidas own ogbonge pass
Time magaxine sef name am inside dem '2011 pipu of the yea' and in na also goodwill ambassador for UNICEF, but na d way in dey take dribble, dey pass, come use style score make am wetin in b today.
In dey play for attack, but dey drop kollect ball anywhere inside field, dey play like small pikin wey just dey enjoy inself.
" I no fit shout, wetin i fit tok again? Dat boy na winch, e too much" Real Zaragoza coachi Jose Aurelio Gay tok dat time for March 2010.
" If no b Messi, we for beat Barcelona, but we no fit beat Messi, if we score four, in fit score 12"
WTF !!!!!!
Is Nigerian now a language ?:erm:
Supersport should hire editors.